
Sultan of Sokoto Muhammad Sa’ad Abubakar wey be leader of Nigerian muslims don confam say na Sunday go be Eid el Fitr as moon sighting committee don report to am say pipo no see new moon.
See church wey open dia doors for Muslims to enta pray
Fotos: Many pipo for Kano no use facemasks, observe social distancing during Friday prayers
Statement wey di sultanate release on Friday add say make Muslims continue to pray for di progress of Nigeria for dis important religious time.

Muslims go mark Eid-al-fitr celebration for house? Dis na wetin we know
How to observe Ramadan dis coronavirus period
Earlier on Friday, Saudi Arabi wey be di holiest land for Muslims also confam say dia Eid go also be on Sunday as e be say dia moon sighters no see new moon.
Wetin you suppose know about Ramadan fasting
Although some state goments dem like Kano, Jigawa and Nasarawa don give go ahead for mosques and churches to open for dis period, dem draw ear warn say pipo must wear face masks, observe social distancing and wash dia hands to help stop di spread of coronavirus.
As e be Nigeria don announce Monday and Tuesday 25, 26 of May as public holidays to celebrate di Eid.
SOURCE: BBC NEWS